Sunday Igboho don regain im freedom now for Benin Republic?

oruba Nation agitator, Oloye Sunday Adeyemo wey pipo sabi as Sunday Igboho, don get freedom to leave Benin after dem bin hold am prisoner afta about two years according to reports.

Tori about im release break on the 8 October 2023 afta im post a thanksgiving video for im Instagram, to say thank you to former President Olusegun Obasanjo and oda prominent personalities for Nigeria.

Lawyer wey dey represent Sunday Igboho in Nigeria, Yomi Aliyu SAN and one of Sunday Igboho aide, Ademola Omiyale confam dis tori to BBC Yoruba say true-true Sunday Igboho don dey released and e dey on im way to Germany.

For interview with BBC Yoruba, im lawyer, Yomi Aliyu SAN explain say nothing dey stop Sunday Igboho from entering Nigeria now wey di goment don release am, as dem no get any case with am.

“If Benin say im dey free to go and say e no offend dem, im fit enter Nigeria now. Im fit come into di kontri if im want.”

swattvafrica

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *